CommunityWorld

Eid Mubarak: How di Eid-el-Adha celebration take happun for Nigeria and across di world

(BBC) Nigeria join Muslims across Africa and di rest of di world to celebrate di 2021 Eid-el-Kabir festival.

Di Eid el Kabir na big feast wey Muslims dey celebrate every year to mark di end of Hajj.

Nigeria President Muhammadu Buhari attend di Eid prayers for im home town Daura, Katsina state.

For im Eid message to Nigerians, e say im know say di economy dey suffer sake of di coronavirus pandemic and flood wey scata plenty farmlands but e assure Nigerians say make dem no worry as goment dey do everything to improve di economy and security.

See oda fotos dem across di world

Ghana President Nana Akufo-Addo wit National Chief Imam, Sheikh Osman Nuhu Sharabutu for di forecourt of di National Mosque for Ghana complex to celebrate di Eid-ul-Adha.
Wetin we call dis foto,Ghana President Nana Akufo-Addo wit National Chief Imam, Sheikh Osman Nuhu Sharabutu for di forecourt of di National Mosque for Ghana complex to celebrate di Eid-ul-Adha.
Ghana National Chief Imam plus oda worshippers for di Eid prayers.
Wetin we call dis foto,Ghana National Chief Imam plus oda worshippers for di Eid prayers.

For Mali, some men bin attempt to stab Mali interim President Assimi Goïta inside mosque for di capital, Bamako.

See foto of President Assimi Goïta (with blue) before di attack
Wetin we call dis foto,See foto of President Assimi Goïta (with blue) before di attack

Col Goïta bin dey attend prayers to mark di Muslim festival of Eid ul-Adha for di Grand Mosque.

However authorities don confam say e dey “safe and sound”.

Back to top button
%d